READ THE RHAPSODY IN NAIJA PIDGIN LANGUAGE

Published Date: Dec 1, 2024
Last Updated:
JESUS WONT DI BEST FOR U
U si mi bifor dem born mi. All di days wey I go live, dem rite am for ur book. U arrange evritin even bifor dem kom to pass. My God, si as wetin u dey tink abat mi make sense Dem nor fit numba dem! (Psalm 139:16-17 NLT).

Som pipol dey fear to allow Oga Jesus Christ do wetin E wont for dier life. Dem tink sey e go shange dier dream; dat dream wey dem don dey hol strong all thru dier life; dat pishure wey dem don paint for demsef. Dem feel sey e fit lead dem to bikom somtin wey dem nor wont, so dem go dey worry.

Di only pipol wey rily dey tink like dis, na dose pipol wey nor know who Jesus bi. Nd bikos dem nor know am, dem nor fit trust Am. If u eva get to know who E bi, u go learn to trust Am. Tink abat am: all E eva wont na di best for u. so, u fit trust Am wit ur life.

Di Lord get intrest for evritin abat u. E love u more dan u love ursef. E get plan for u, nd dat plan na to make u succeed nd get joy evritime. 

E tok inside Jeremiah 29:11 NIV, sey “Bikos I know di plan wey I get for u,” sey di LORD, “Plan to make u prospa nd not to suffa u, plan to giv u hope nd future.” No oda persin fit get dis kin plan for u. E dey also dey karri kon mind E sweet word inside 3 John 1:2, “My friend, I dey pray sey make evritin dey gud for u nd make ur bodi well, jus as ur soul well too.” Tink abat am!

Na di rizon E giv u E life, E risiousness, E glory, nd E Name; so u fit live high above Satan, sin, sikness, disease, infirmiti, nd death. Glory to E Name foreva! 


PRAYA

Risious Baba God, tank u for ur love wey nor dey shake nd di korrrect plans for my life. I trust u finish, nd I know sey ur plan na to prospa mi, giv mi hope, nd secure my future. I choose to follow ur guidance, I dey sure sey I go alwayz live life wey get joy nd fulfilment, in Jesus' Name. Amen.

About the Author

Next Post Previous Post
No Comment
Post a Comment
comment url