TOK WETIN U WONT IN E NAME: RHAPSODY OF REALITIES IN PIDGIN ENGLISH

Published Date: Dec 3, 2024
Last Updated:

     TOK WETIN U WONT IN E NAME
And dis signs go follow pipol wey bilive: Wit my name, dem go drive demon komot from pipol bodi; dem go speak new language wey dem nor learn (Mark 16:17).

To dey koll di Name of Jesus nd to use di Name take demand for somtin dey differen. Tink abat Romans 10:13; e sey, “E go save any bodi wey koll on di name of di Lord.” Sinners fit koll on E Name for salvasion, but as Christians, we dey use E name; wi dey use di powa in E Name.

To dey use E Name nor bi to dey koll Am out as if u still bi sinner wey dey find salvasion. Now wey u don giv ur life to Christ, u don bilong to God household. Di name of Jesus dey on top u, nd e don giv u to live by am. U nor nid to koll on Am any more for anytin; insted, use E Name wit authoriti to kreate anytin or get any shange wey u desire.

Obsav sey for awa vas wey wi take open, sey E nor tok sey, “Koll my name nd I go drive di devil kom out nd heal di sick”; no! Insted, u suppoz use E Name take drive out devils, heal di sick, clean di lepers, nd raiz di dead. E name na instrument; use am! Inside John 14:13-14 E tok sey, "And anytin wey u go ask in my name, I go do am…if u ask anytin in my name, I go do am.”

Si strong word! Dat one min sey u fit ask for anytin in  E Name nd e go hapin. For exampo, if u dey any mata wey dey giv u wahala, insted of u to dey shout "Jesus! Jesus! Jesus" as if u nor get hope or u dey panic; tok wetin u wont in E Name. Tok wit di powa E giv u. U go sey, “In di Name of Jesus, I demand healin,” or “In the Name of Jesus, u devil of darkness, I kommand u make u komot ur hand nd get out!” 

Always rememba sey u dey in charge nd in kontrol bikos u dey function in di Name of Jesus. Evritin for dis life, weda physical or spiritual, even govaments, thrones, di galaxies, principaliti nd powas, all of dem dey bow to di Name of Jesus. Tok wetin u wont in E Name wit confidence nd u go get ur testimoni. Glory bi to God!

                     PRAYA

Dear Baba God, tank u for di powa nd authoriti u don giv mi to use di Name of Jesus. I dey waka in dis authoriti nd I dey use dis dominion ova any condition nd mata. I dey tok healin, peace, nd prosperiti in E Name, nd I tank u for di confidence nd assurance wey dey kom wen I dey use di Name of Jesus to cause shange nd bring wetin u wont to pass. Amen.

About the Author

Next Post Previous Post
No Comment
Post a Comment
comment url